Osun state election result 2022: PDP Ademola Adeleke win governorship poll – Results from di 30 LGAs

PDP candidate, Senator Ademola Adeleke don win di Osun state govnorship election wey happun on Saturday,16, July, 2022.

E win 17 out of di 30 local goment results wey di Independent national electoral commission announce to win.

Di election see ogbonge contenders battle to become di number 10 govnor since di creation of di state for 1991.

Na fifteen candidates bin dey di race to become di next govnor of di South Western state.

Ademola Adeleke wey be di candidate of di main opposition party for di state emerge winner afta e poll 403,371 to beat im closest rival Adegboyega Oyetola of di All Progressives Congress wey polled 375,027.

Move around di map to see breakdown of how Adeleke win

Na Nigeria Independent National Electoral Commission, INEC announce di winner of di election.

According to INEC, di requirements to declare winners for Presidential and Governorship election na di simple majority of votes cast.

Dis wan mean say di winner must win di one quarter, (25%) of di votes cast for two third of di States of di federation (for Presidential election) or of di LGAs within a State (for Governorship election).

Nigeria dey operate di first-past-di-post system irrespective of voter turnout and no be di 50%+1 voter turn out for some jurisdictions.

See profile of di top candidates (Click di drop-down near di candidate name to read more about am)